Canada Prime Minister don talk say " I don tire, I nor dey do again!!"
My pple, PidginParrot don showcase with another tori oh.
Oga at the top for one oyibo country wey dem dey call Canada don talk say the work don tire am like laborer wey neva chop and him nor dey do again.
This guyman wey him naming ceremony na Justin Trudeau bin don drop him resignation letter after nearly nine years wen im don dey run things for the country. E talk say dem don dey press him neck too much for him party and say based on say im own pple don dey vex for am naim make am talk say e nor do again.
The guyman been don gather different pple wey their job na to give the pple for the country different gist on Monday con talk wetin dey him mind like wife wey den nor give chop money, but him talk say him go still chillax for the office untill him party wey dem dey call Liberal Party arrange another oga for dem selves.
Pple wey bin don reason the guy mathais here and there bin don yarn say during the time wen the guyman dey work, e bin get plenty plenty underG wahala wey make pple dey vex for am as dem no con dey happy with the way him dey do some things for the country.