When the Jamaican people speak their Creole, everyone loves it, they all want to speak like them. You know why ? It’s because they appreciate and show pride when speaking the creole. But as for my fellow Naija man, he doesn’t want to speak pidgin because he feels pidgin make people think less of him, that he his uneducated, not civilized and probably local. According to wikipedia, the official language in Nigerian is English but we all know that the common language we speak in Nigeria is Pidgin. Nwanne be proud to speak your pidgin whether it is the simple pidgin or waffi pidgin, that doesn’t stop you from speaking good english when you want to.
Man wey naked no dey put hand for pocket
loose translation: You can’t do somethings if there are no certain conditions.
Chicken wey run way from borno go Ibadan go still end up inside pot of soup
loose translation: You Can’t Run Away From Your Destiny
Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap
loose translation: Keep calm! Nothing last forever
Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef
loose translation: Just be patient. Let the game come to you. Don’t rush!
Akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem diffrent
loose translation: How you start doesn’t matter, what matters is how you finish.
To piss no hard but fowl no fit.
loose translation: It’s easy doesn’t mean everyone can do it.
NO matterhow dark room wan be, man go still locate woman breast.
loose translation; There is always a way when something matters much.
Custard na just pap wey jand
loose translation: Appearances are often misleading. – Looks are decieving
Wetin concern agbero with twitter handle or malu with face cap?
loose translation: Mind your business.
If life dey show you pepper my guy make pepper soup
loose translation: Make something good out of a bad experience
I get am before no be property
loose translation: Stop living in the past and start living in the present.
If person too tey for party e go follow dem wash plate
loose translation: Don’t outstay your welcome
Rolling stone, of course na person push am now!
loose translation: There is always a reason for something
Craze no hard to form,na the trekking be wahala
loose translation: Easier said than done
No matter how hot your tempa be,e no fit boil beans.
loose translation: Calm down,your temper won’t solve the problem
Every mallam with em own kettle, every aboki with em own radio.
loose translation: Every man for himself
You no need cutlery to chop slap
loose translation: You don’t need my translation to understand this
Opolo eye no be open eye
loose translation: Having Big eyes doesn’t make you civilised
Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus.
loose translation: Let sleeping dog lie
Bring suya, bring suya….na cow body dey suffer am.
loose translation: Every action has a consequence
E go better na e go better, na im make ibo man still dey Kano
loose translation:When there is hope,there is Life.
Escort me, Escort me, na im slave trade take start.
loose translation: Serious things sometimes start like joke
Na from play play dem dey form PLAYER
loose translation: Serious things sometimes start like joke
Pikin wen use agbada take stat guy go talk wetin e go wear wen e old.
loose translation: Slow and steady wins the race
The water wey dem use take make eba can never be recovered back.
loose translation: Don’t cry over spilt milk
Nearly no dey kill bird.
loose translation: It’s either you have it or you don’t
Fly wey no get special adviser na im dey folow dead bodi enta grave
loose translation: Don’t stay ignorant
No matter how lizard dey do press up e no go get chest like aligator
loose translation: Be proud of who you are
The cassava today fit be gari tomorrow
loose translation: No condition is permanent
If mad man don beat ur mama before,if she see mechanic she go run…
loose translation: once beaten twice shy
Jollof Rice wey dey for d bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro
loose translation: no condition is permanent
Fowl wey dey carry for head no dey know say to waka na work.
loose translation: A dependent would not know the value of what he/she is enjoying.
Na from clap dance dey start.
loose translation: Big thing don’t happen suddenly!
Cockroach wey dey form swagger… if e summersault reach fowl place na for lindaikeji dey go read im tori