Welcome
Guest:
Register on Agbazilo
/ LOGIN! / Leaderboard / Refer and Earn / Recent / New 223 users and 360 visitors this Month |
Pidgin-tori / 3 Story Building Don Fall Yakata For Rivers State Oh!!
by PidginParrot_ng :09:34 PM
on Jan-05 |
---|
3 Story Build don fall yakata for Rivers state oh!!. My people, my people! PidginParrot don bringth another tori oh. Dem say one 3 Story building wey dem dey build for Aboga, around Igwuruta-Etch road don knack headpan for ground. The tori wey still follow na say like 7 men dem don collect different kinds of wound follow body as the building touch ground. News stations wey carry the tori say the mathais happen on Saturday afternoon as the men dey do workshop on top the building. Dem say government authorities manage to commot the people wey dey work for the building before them kpai. Say the last person wey dem commot for evening time naim woundjure pass, so dem gatz to rush am go hospital sharp sharp inside moto wey hospital dey take carry pipo wey wan nearly kpai. The tori still yarn say na the community people them, with local authorities for Ikwere and Ministry of Physical planning and Urban development naim join body take drag the men dem commot for the building as e touch ground. Dem say ministry of special duties naim quickly free catapillar wey dem dey call excavator send go where the building bin knack for ground wey make dem fit sharply commot the men wey bin pin under the building. Hon. Evans Bipi, wey be the commissioner for Physical Planning and Urban Development for Rivers State wey chuk mouth for the mathais through him Press Secretary wey him naming ceremony na Emeka Idika yarn say the matter just get as e be. Say nor be better way to take start the year for the state. E still yarn say na materials wey nor gallant wey the person wey dey in charge of the building bin dey use naim make the building fall yakata like Goliath when e collect stone for head. E talk say any person wey go dey use 12mm rods for decking dey find government trouble as nor be wetin government say make dem dey use oh. E say nor be d first timebomb wey this kind things fall apart dey happen for the state, as plentiful building don knack for ground becos of the yama yama materials wey contractors dem dey use build. E say government go begin chook eye wella on top this kind matters so that e nor go dey happen again. Say any person or company wey dem corner wey dey use material wey nor gallant go collect woto woto from Rivers State government hand. 1 Like 1 Share |
Agbazilo © 2023 All rights reserved. Rules and Regulations, Privacy Policy, Terms and Conditions Email At: Send Email Disclaimer: Every Agbazilo member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Agbazilo. |