Welcome Guest: Register on Agbazilo / LOGIN! / Leaderboard / Refer and Earn / Recent / New
Stats:
230 members, 1364 topics. Date: Wednesday-05-February-2025 07:57 AM

223 users and 360 visitors this Month

NigeriaNDLEA Don Catch 2 University Student For Ilorin Wey Dey Put Igbo Inside Cake. - General - Agbazilo

Agbazilo Forum / General / NDLEA don catch 2 university student for Ilorin wey dey put igbo inside cake. (6 Views)
    (Go Down)
(1)

NDLEA don catch UniIlorin student and another one wey just commot for school wey dey put Igbo inside cake oh!!

My pple dem, PidginParrot don land with another tori oh.

The tori be say government agency wey im job na to close mark bad bad medicine like Igbo and codeine wey we nor dey allow for we country don catch one UniIlorin student and another one wey bin don finish from the same school, say cos say dem dey put Igbo for inside small cake wey dem dey call "cupcake" con dey sell an upandan to their fellow students.

The one wey don finish school wey im naming ceremony na Khadijat Abdulraheem and another student wey im name na Ayomide Morakinyo bin enter Ndlea men dem hand for around Oke-Odo area for Ilorin.

Extra informate for social media yarn say Ndlea bin find the bad bad thing wey dem dey put inside the cake when dia strong men bin go check the house wey the boys dem bin dey pin based on one or two coded aproko wey their underG men bin don collect on top the boys their two headpan.

The tory yarn say na when dem bin scatter everywhere dey check check their room like pesin wey lost money naim, dem find about 42 cakes wey dey don put the yeye medicine inside already.

The man wey im workshop for Ndlea for that area na to dey gist pple confirm gist on top matters as e take concern the agency bin confama the tory. E talk say dem go use wetin dem locate for their room as evidence take carry the two boys go law court make judge fit reason their mathais con punish dem based on how the law take talk am for we country.

E con advise say make yoots for we obodo country nor dey do all dis kain yama yama thing as government nor get joy and nor go waste time pepper anybody wey think say them fit do anyhow for we country. E still yarn say make yoots learn from wetin don happen as any yoot wey do anyhow go see anyhow for government handicap.

Nazo the tori be oh my pple!!.
(1)

Oops! Must be Logged in to REPLY

LOGIN or Create an Account
(Go Up)

Agbazilo © 2023 All rights reserved.

Rules and Regulations, Privacy Policy, Terms and Conditions Email At: Send Email Disclaimer: Every Agbazilo member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Agbazilo.