Welcome Guest: Register on Agbazilo / LOGIN! / Leaderboard / Refer and Earn / Recent / New
Stats:
230 members, 1364 topics. Date: Wednesday-05-February-2025 07:53 AM

223 users and 360 visitors this Month

NigeriaSaudi Don Free 3 Naija Pple Wey Dem Bin Gbap For Yama Yama Medicine Matter. - Pidgin Tori - Agbazilo

Agbazilo Forum / Pidgin Tori / Saudi don free 3 naija pple wey dem bin gbap for yama yama medicine matter. (6 Views)
    (Go Down)
(1)
Saudi Arabia don free 3 naija ladies wey dem bin gbap for bad medicine wey dem bin carry for body.

Mutane minna!!. PidginParrot don bring anoda Tori oh!!

Saudi Arabia don free 3 pple wey come from our obodo naija wey dem bin don gbap for wan bad thing wey dem do after dem don spend 10 months for cooler.

The 3 naija pple wey dia naming ceremony na Hadiza Abba, Fatima Malah and Fatima Gamboi bin don enter Saudi Arabia government hand, based on say the government bin dey reason say din carry on yama yama medicine wey dem dey call "cocaine" hold for body when the 3 of them con don pilgrimage for the country.

Comfam yarn wey bin commot from Abuja on Sunday by the 2-IC person wey dey him job na to give confama gist, him name na Kimiebi Ebienfa bin yarn say dem bin don free the 3 of them based on some oga at the top cho cho cho between Naija and Saudi Arabia government.

Based on the informate wey bin dey inside the gist, dem bin don gbap the 3 of them for one of dia airport wey dem dey call Prince Mohammad bin Abdul Azeez International Airport Madinah, Saudi Arabia. The tory talk say den bin don gbap dem be based on another 2 naija pple wey den bin don gbap before before wen bin carry the same yama yama medicine. 

Them talk say the beta freedom wey the women don get na based on the padi padi 2 aside wey Saudi Arabia government and our own Naija government don dey do since then been don gbap den.
Na one Ambassador Muazam been dey on ground to collect the pple dem as den been don land for one of our branch office wey dey Jeddah.

https://www.vanguardngr.com/2025/01/saudi-arabia-releases-three-nigerian-ladies-after-10-months-in-jail-over-drugs/ 1 Like 1 Share
(1)

Oops! Must be Logged in to REPLY

LOGIN or Create an Account
(Go Up)

Agbazilo © 2023 All rights reserved.

Rules and Regulations, Privacy Policy, Terms and Conditions Email At: Send Email Disclaimer: Every Agbazilo member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Agbazilo.